This our Beautiful yellow sisi actress Doris Simeon wey don seperate from her husband man actor Daniel Ademinokan some years ago for one interview talk say Nollywood actresses dey get many sex partner.This actress tell YES INTERNATIONAL magazine say na free world we dey if dey wan sleep around and na mata of choice.According to her she talk say"Dat impression no dey right and na big lie,But na free world if anybody wan do am,d person go do am.She say na mata of choice but e no mean say na all the women for the industry dey do am and na dat is why dey never marry'
She also talk say many people dey wey dey live their life the way dey want and no be everybody know about am but na because of say them be celebrity that is why people they think say them too no get private life and everything wey happen dem too go wan know as if na dem born dem.she say na one of the things wey them dey face as actresses.
When she dey try explain the mata wey dey ground she even kon add join say"sometimes this their work they bring the wrong men to them and even if e bring the wrong men to them na still mata of choice,she say na only you fit choose wetin you want and na the thing go happen"
Hmmm! Dis kind of gist nawa o! Me no know wetin i go talk o but wetin i go talk be say make our celebrity dey show good example,make dem be good role model for other people wey dey watch dem.We know say e no easy but make dem try make the bad part of them no over shadow the good part of them.Na advice i dey advice o! I no talk anything o!
No comments:
Post a Comment