Wednesday 16 September 2015

See how dem find Scissors for Nigerian Pilgrim's Belle for Saudi Arabia

Wonders dey happen for this life,dats why e good make we dey careful especially Doctors and Nurses because dis person wey dem see this scissors for him belle talk say him be do operation for hospital nearly 15years ago and him no feel any pain.The reason why dem be know say scissors dey him body be say the metal detecting machine for the airport wey dey Saudi Arabia no stop to dey make noise when dem dey scan the man.Abeg make our Doctors and Nurses dey always dey careful with their patient when dem dey operate on dem.

No comments:

Post a Comment