Monday 19 October 2015

John Legend's Wife,Chrissy Teigen Don Talk Say She No Dey Get Twins


Chrissy Teigen don deny the rumour wey peopl dey talk say she and her husband dey expect twins after when commenters suggest say the model's baby bump dey too big for just one child.

Una don hear am,una wey dey carry rumour!

Nollywood Veteran Actor,Zack Orji Don Talk Say Him Be Pastor Since 3 Years


This our Naija actor,Zack Orji wey don act over hundreds of movie talk for one interview with City People say him don become reverend since 2013.

Him talk say him be ordained reverend and pastor so him dey get invitation to minister for different churches both within and outside naija,him say even him currently get angagement for South Africa this October.

As him dey talk why him decide to be a pastor,him talk say him no ready to become reverend,na him Bishop wey God probably inspire am to ordain am.

Him Say him dey worship with Power Line Bible Church wey dey under Bishop Lawrence Osagie,and him ordain am in 2012.Him talk say even before them ordain am him bin dey receive invitations from different places to come minister,so when the offer come from him bishop to ordain am him no reject the offer.Him take the offer with him whole heart and him come dey happy as him come get opportunity to talk with people,inspire them and draw them closer to God.

This one na better thing bross! God go strengthen u in ur ministry!!!

Appeal Court Don Adjourn The Judgement On Saraki's Case


On Monday,them shift The Appeal  by senate president Bukola Saraki against the jurisdiction of the Code of Conduct Bureau  (CCB) to try him over alleged false declaration of asset to indefinately by court of appeal wey they sit for Abuja.

Commedian,Eddie Murphy Don Return On Stage After 28 Years,Him Come Slam Bill Cosby


Eddie Murphy don come back on stage after almost 28 years and Bill Cocby be one of him target while him be dey receive the Mark Twain Prize for American Humor for Kennedy Centre in October 18.

Him call the prize a 'tremendous honour' but him no wait to add warning to Cosby.

Man Crush Monday: Uti Nwachukwu Be Their Guest


Today's Man Crush Monday na nollywood actor Uti Nwachukwu.

The 33years old celebrity come from Delta state,Uti start to dey become popular when him be contestant for Big Brother Africa in 2008,as we know he come win the show in 2010 when they recall am.

Uti Nwachukwu get Bsc in computer science an education from Benson Idahosa University.THey regard Uti as one of the top nollywood and one of Naija most desirable celebrities.

Apart from acting,him be th host of MNET show "Jara".Last year him be the host of "Star The Winner Is"

Because of him achievement in the entertainment industry,his alma mata award am in Appreciation an Recognition of him role in Advancing the Entertainment Industry.

E get one time wey people bin dey carry rumour say Uti bin dey date one upcoming singer,Saeon.Abeg no me talk o! na wetin people talk o!

Veteran Rapper,Eedris Abdulkareem Don Accuse Buhari Of Killing Fela Anikulapo Kuti


The former Remedies rapper go on stage for the ongoing felabration to accuse the president of killing the founder of afrobeat Fela Kuti.

Them arrest Fela plenty times under various military regimes.Them sentences Fela for 5years in prision under the then Buhari regime for currency smuggling in 1986 something wey several right groups like Amnesty international consider as political motivation.

Fela come get him freedom two years later when Gen Ibrahim Babangida come take over power from Buhari.

Reporters talk say Seun Kuti one of Fela sons show dissatisfaction when Buhari come back as democratic president.

Blogger,Linda Ikeji Talk Say She Never Sleep With Any Man For Money


This pretty blogger write on her blog say her name na Linda Ikeji,she be blogger,she be 35years old and she never sleep with any man because of money and not only say she never sleep with any man,she never even consider the thing for her mind....and see her now with her house wey cost her half a billion naira.

She come say make una listen,you dey beautiful and even strong pass the way u know sef.She say nothing dey wey u no fit achieve if u put your mind to do am.Uptill 5years ago she be struggle entrepreneur,she no fit count how many offices for Lagos she don sit down for hours where she dey wait to see people wey fit support her business........but most times she no dey even pass the reception area.But she no give up and stop believing,now see her today where she dey.

She talk say you too fit do pass this one,no dream dey to big and no dream dey too small,no mountain dey too high,all dey your mind.E dey up to you if you elieve in yourself and in your God who dey guide u,the sky na just yout starting point.

She say make una stop to dey wait for men to give to you...to give you clothe and food.She say she promise you u can do it for yourself,e creative and start working....make you know say your dreams dey valid..and nobody fit make your dreams come true except you.

Find somthing wey u dey good at and you get passion for.Work hard towards that thing wey you like and make you dey consistent,patient,start young even if you no dey young,e never dey too late!

No be lie!!! na true talk!!!  

5 Things Ex-Minister,Diezani Pioneered


During Diezani tenure as petroleum minister she achieve some pioneering difficult accomplishment.

See the first 5 of ex-petroleum minister.
1. Mrs Alision Madueke na the first woman to hold the position of Minister of petroleun resources for Naija.

2. In Octoer 2010,she ecome the first woman to head one country delegation for the annual Organiztion of the Petroleum Exporting Countries(OPEC) conference.

3. She also be the first female minister of transportation.

4. She be the first woman wey them appoint to the board of Shell Petroleum Development Company Nigeria.

5. On the 27th of Novemer,2014,she become the first female president wey them elect as President of Organization of Petroleum Exporting Countries(OPEC).

Hmmmmm! no be small thing ooo!

Sunday 18 October 2015

Pop Star,Burna Boy Dey Quarrel With South Africa


Recently Burna Boy they reply South African artiste wey dey talk say na South Africa make am wetin him be today.

Burna Boy come tell people say wey dey carry rumor say him live for South Africa,na only business and holiday carry am go there.

DSS Don Commission 385 Officers To Tackle Insecurity


During weekend Department of State Services (DSS) commissione 385 cadet officers to fight the rising problem of security for we country.

The 385 0fficers na the lucky one wey successfully pass the 10 months professional academic and physical training and qualify to serve their nation in their ouw capacity as members of DSS out of 459 cadet officers wey start the training last year.

See Official Photos From Ebony Life TV "Fifty" Movie Premiere For London,UK













Akpabio: PDP Talk Say Buhari Na Dictator


The Presidency and Peoples Democratic Party bin quarrel yesterday over President Buhari anti-corruption crusade following the provocation of the former Akwa-Ibom state governor and Senate minority leader,Godswill Akpabio by the Economic Financial Crime Commission EFCC.

The opposition talk say the anti-graft group they selective and President Buhari be dictator,and they ask am say if him dey sincere why him go after all APC governors who write petition against am for alleged corruption.

Immediately the Presidency talk say the PDP party na partyt wey need pity because them no get idea again.

Following the persecution of Akpabio,the national leadership of PDP talk say their move dey political design to weak PDP ahead of 2019 Presidential election.Acording to PDP,instead make them allow EFCC go after former Apc governors wey them petition them come dey compensate them with ministerial positions.

Hmmm! dis one no be small quarrel o!

Female Sucide Bomber Die When She They Prepare Attack For Army Base


For Maiduguri yesterday,Nigerian Soldiers kill one suspected suicide bomber outside one millitary base for Maiduguri inside Borno state.Na one civilian vigilante and military source tell newsmen.The shooting indicate say explosive they inside her handag.

Them bin think say the target na Maimalari Army barracks the main military base for Maiduguri wey the terrorists group dey attack of recent.

Babakura Kolo,one civilian volunteer force wey dey help the troops against this terrorist talk say soldiers wey dey for Maimalari army barrack yesterday morning open fire on one female suicide bomber wey one attack the barrack.


Saturday 17 October 2015

EFCC Invitation:Akpabio Talk Say Him No Get Anything Wey Him Dey Hide For Him Tenure

During the arrest and the immediate release of Godswill Akpabio by EFCC,him talk say him no dey hide anything for him tenure.

EFCC invite Akpabio Yesterday  around 5:20pm to Abuja over one petition wey them write for June 22, 2015 and them address the letter to President Buhari and EFCC.

The petitioner,Leo Ekpenyong tal say Akpabio use fraud collect 108,1billion naira wey belong to Akwa-Ibom state during him tenure.

Hmmmm! no be small matter o!

The US And Intellegence Don Talk Say Them Go Help Fight Boko Haram


Them don arrange 300 US soldiers wey dey for Cameroon make them provide nations around lake Chad with the things wey them lack for battle to fight against boko haram.


Friday 16 October 2015

Falae Don Identify The People Wey Kidnap Am

The former secretary to the federation chief Olu Falae wey the Fulani herdsmen kidnap on him 77th birthday and release am after wey dem don pay 5million don identify the kidnappers wey the police people show am.

Chief Falae i dentify 3 of the kidnappers wey kidnap am and threatened am say them go kill am if him no pa the money wey them ask for.Him also identify one of the kidnappers we dey kind to him.

Them don carry the five kidnappers go High Court for Ondo and the trial go start for november 10th and chief Falae go be the star witness.

ThankGod o!

Thursday 15 October 2015

See How One Woman 7 Years Old Daughter Die For Calabar As A Result Of Generator Fire


One woman and her 7years old daughter die on wednesday from one generator fire wey burn their house wey dey for no 15 Andem street,8 miles we de outside calabar metropolis for Cross-River state.

Reporter also findout say two other families including the husband of the woman wey die Mr Lawrence and him brother in-law get injury and them currently dey hospital.

People talk say the the late woman and her daughter bin dey try to put fuel for the generator before e catch fire.But before the the husband of the woman tell the brother in-law make him go repair the generator because e don tay wey dem use am.

Shai!!! Make their soul rest in peace...

Monday 5 October 2015

EFCC Don Go London With The Documents Wey Them Find For Diezani House For Abuja For Her Bribery trial


The Presidency don confirm last night say the Department of State Service(DSS) dey join body with National Crime Agency (NCA)for Britain to get to the root of the bribery and money laundering accusation against the former minister and four other people wey them never mention.

EFCC don make plans to send some of their teamto London make them go witness the trial of Alison Madueke.

Sunday 4 October 2015

Nollywood Actress Stephanie Okereke Linus Dey Encourage Women To Join Politics


For one radio programme "Talk your own make Naija better" the heavily pregnant actress talk say when men and women come together,beautiful things dey happen.

She talk say when we all take part for government we dey build better lives for ourselves and our children.So women go vote,contest for political offices,make people hear their voice and make all women support this one.She say if we no take part for government,we no fit create beautiful future,so make we build somthing beautiful together.

Better talk jare!

Jarule Veteran Rapper don Announce Say Him Dey Go On World Tour


Jarule don announce say him dey plan to go on world tour and film project with Ashanti

Kogi Don Raise Alarm Over The Rising Of Flood


Kogi state government don raise alarm over the way wey water dey rise for their state and him dey beg those peoplke wey dey live around those floody area make them run leave the place and go where dey safe for them.

Federal Government Talk Say Him Go PayThe Bills Of The Bomb Blast Victims


For Abuja yesterday,presido don assure all the victims of friday bomb blast say him go take resonsibility to  pay their medical bills



Make Una See Pictures Of Our Naija Celebrities As Them Storm Posh Cafe Wey Dey For VI,Lagos For Afriff 2015 Film Selection Party



Last night our nollwood celebrities come together for the official announcement of the film wey them select for the upcoming  Africa  International Film Festival(AFRIFF).