Wednesday 23 September 2015

Buhari Don Order IG Make Them Go Save Falae Immediately

Presido don order Inspector General of police and other security agencies make them go save Chief Olu Falae wey them kidnap for him farm since on Monday.

The special adviser to the president on Media and Publicity.Mr Femi Adesina talk say Buhari condemn the actions of the kidnappers wey kidnap the former Secretary to the Government and elder statesman.

Today Na This Beautiful Celebrity,Cynthia Morgan Birthday And She Is 24 Years Old

HBD! WIshing you LLNP and all the good things of life.Enjoy!

This Singer,Kach Don Drop Another Singe Tittle"Olo"

Signature Records musician,Kach release him first official single tittled "Get Up" wey Sarz on the Beat be the producer.

Him come release him second single this year tittle "Olo" and Mazi C.I.Jizzle be the producer and them shoot the video for Naija.

Them Don Arrest Suspected Boko Haram For Inside Lagos

The Nation don report say them catch one suspected boko haram yesterday,Abdullahi Adamu.

One observant wey live for Ijora for Lagos go tell Operation Mess(OP) Security operatives so them come go catch Adamu for Ijora 7-Up area of Lagos where him dey hold one box wey bombs and AK47 guns full inside and him keep for the ceiling of him house.

Thank God o!

The Ex-Governor Of River State,Ameachi Don Sue PDP For 300Billion Naira

Ameachi don carry the chairman of PDP wey dey for Rivers,Felix Obuah to Abuja High court because him accuse of ownership of foreign account and embezzlement

Him dey find 300billion naira because of the damages wey them done to am and the way dey stain him name and person.

Hmmm This money plenty o! na em one person want make them give am,there is God o!

See Naked Pictures Of Beverly Osu And Her Reasons Why She Post The Pictures


Beverly talk say the reason why she post the picture  na her own way wey she dey take teach upcoming models how to dey comfortable with their body because she enter modelling by wearing female underwears.

She say she force herself into undwear modelling because she no like to be a run away model.And primarily she wan teach people how them go take dey comfortable with their skin.She say people think say she dey expose her skin but to her na her skin and them no see anything.

And she say she wan make clear to people say she no dey follow Kim,she say Kim na social celebrity while she be model but if u tell her say she they follow Tyra Banks she go say YES.

But i wan ask o,shey na only when u expose your body u go fit be correct model? hmmmmmm! different people with different thinking,Baba God help us ooo!

Labour Don Petition Inspector General Wey Dey For Akwa-Ibom State Because Of Police Abuses

The organized labour wey dey for Uyo don petition Inspector General,Mr Solomon Arase because him dey help increase ilegal activities by officers and men wey dey for Nigeria Police wey dey for Akwa-Ibom.

Base on wetin National Union of Chemical,Footwear,Rubber,Leather and Non Metallic Product Employees talk,them specifically point out Ikot-Ekpene as the major area where police men dey do their ilegal activities wey fit cause problem for the state regarding to the security wahala wey dey for Naija.

According to wetin dey for the petition,the president of the union,Mr Boniface Akpan Isok him talk say the police wey dey for Ikot-Ekpene dey harass and collect money from okada people and arrest them without any reason for their house.

Beautiful NAija Actress,Halima Abubakar Don Collect African Women Award As The Most 2015 Dynamic Nollwood Actress



Over the weekend the organizers of the African Women Award don give this Kogi fine babe,halima Abubakar award as the most dynamic actress in 2015.

Congratulations to you!

Tuesday 22 September 2015

This Our Beautiful Naija Actress,Ireti Osayemi Din Join Nollywood Nose Ring Gang



Ireti don follow people like Rukky Sanda and Eniola Badmus dey wear nose ring.

Dis wan one na all in the name of fashion o! well sha e fit her,

Armed Robbers Don Shoot One Policeman Manhood And The Policeman Dey For Coma

Thief people don shoot one police officer Gbenga Samuel for him manhood.this one happen for Mile 12 market yesterday and the man currently dey LASUTH

Shai! this people wey do this policeman this thing no good o,how them con want make the man dey enjoy him wife na! dis wan na wickedness ooo! Sorry Gbenga,God Go heal u,u hear???

Sean Penn Don Sue Lee Daniels 10Million Dollars Because Him Abuse Am

Sean Penn don Sue Director Lee Daniel 10million dollar because him dey accuse am for violating women

Muslims Wey Dey For Ekiti Don Disobey The Oders Of Some Of Their Leaders Wey Talk Say Make Them No Collect Fayose Ram

Yesterday muslims wey dey for Ekiti disobey the orders of their leaders make them no collect any ram from the governor of Ekiti state,Ayo Fayose as them enter the governor house to collect the ram wey him give for their Eid-el-Kabir party.

The reason why the muslim leaders give this be say their members no dey present for Fayose appointment.

Although another group no support wetin the League of Imans and Alfas do,them say the people wey dey do this thing no dey among the group.

When Fayose dey give out the rams him talk say him no go allow himself to dey involve among the people wey want to bring politics for inside religion for him state.

Him come dey advice him muslim people make them no allow any politician wey want to destoy him government at any slite opportunity use them say instrument of politics.

Two Storey Buliding Don Collapse For Lagos And Them Save Only 2 People

Them talk say two storey building for Lekki area wey dey for Lagos don fall and them save 2 people while the rest people dey trapped inside.

The two people wey them save na two men and na their neighbour wey pity them come save them before the state and federal emergency officials con come.

Diddy Beat Jay Z,Drake Dey Top Forbes rapper Earning List

Diddy don dey work on him long time album,even without him music him still the top the highest earning list.

During when them dey release the yearly list on Tuesday,Forbes talk say Diddy wey him real name na Sean Combs and him stage name also na Puffy Daddy dey take 60million dollars from last year June to June 2015.

The Wealth Magazine talk say him money dey come through him business project especially him business wey him dey sell French-made Ciroc liquor.

Diddy dey haerdly perfom and the last time him release him album na "Last Train To Paris" in2010.

Forbes talk say another Rapper wey dey top the highest earning list na Jay Z and him earning wey them calculate na 56million dollars.Him say the singer earnings dey come from his asset Armand de Brignac,one champange wey him buy last year and the different shows wey him dey go with him wif

Another rapper wey they top Forbes list na Drake the Canadian Rapper and him dey earn 1million per show wey him go.Drake na the only singer wey dey sell more than one million copies with one album wey him release this year,the name na "If you are reading this is too late"

Today Na Micheal Majid Birthday

This Our Handsome Ghanian actor don reach 35years old to wey be 22nd of September.

HBD! Me wey be ameboqueen dey wish u LLNP and all the good thing wey dey for life.

Mente De Moda And Jam Rock Dey Hold Their Abuja Edition For October

Mente De Moda na one of the biggest lifestyle exhibition and them dey go Abuja to go spend time with Naija people.

Make Una miss am o!

Bird Flu Disease Don Enter Lagos


The News Agency of Nigeria(NAN) don talk say bird flu don affect 60.000 birds for Lagos and Mr Olugbenga Ogunsetan the executive secretrary of Poultry Association of Nigeria tell NAN today say  plenty poultry farm for Ikorodu don dey affected.

Hmmm! wahala dey o!

10 Hollwood Don Dey Showcase How Them Rearrange Their Nipple With Nipple Rings


This nipple rings na wetin dey reign for hollywood hot babes and them dey show am and them no mind wetin people dey talk.

People like Kandall,Kylie Jenner and the likes of Rihanna and other seven hollwood babes follow join .

Hmmmmm! nothing wey oyibo people no fit do for this life wey we dey so! Nawa o!

Them Don Verify Our Naija Singer, Davido's Instagram Account As E don Hit 1million Followers

Davido na the first Naija Singer wey get 1million followersw for him instagram where him dey shar him photos/video.

Them confirm this one yesterday.

The Director General Don Warn Say People No Dey Worry NYSC Staff Make Dem Post Graduate

The DG of NYSC,Brig-General Johnson Olawumi don talk say them no go accept any request from people wey dey disturb them make them post their children or relatives for mobilisation
.
Him talk this one during one opening ceremony training wey the NYSC and the Housing Developers,Cooperative Society for Corp Memberes organize for NYSC Orientation camp Kubwa Abuja.

Him also talk say them don introduce self deployment mechanism wey go allow the corp member choose where dey wan serve.

This thing wey them introduce good ooo! so that them no dey post our corpers go some state bad people go bomb them,abeg i no mention any state ooo!

APC Don Tell Metuh Make Him Keep Quite

APC don warn the National Publicity Secretary of the People Democratic Party,Mr Olisa Metuh make him keep quite quite and make him mind the way wey him dey talk when him dey for public./

Make Una See This Silver Television Star,Anne Hathaway Dons Sheer Single Armless Gown Wey She Wear For The NYC Premiere Intern



This 31 year old Oscar winner don dress in her sheer armless gown wey her stylist select for her.

Make una check out the dress.

Monday 21 September 2015

This Celebrity Couple,Chris Attoh And Damilola Adegbite Don Do Birthday Party For Their Son For Charity Home

This Lovely celebrities don celebrate their pikin birthday for one charity home wey dey for Ghana.

This Naija television diva and her Ghanian husband do birthday party for their son,Brian Nii who don become one year old with the children and staff of Osu children home wey dey for Ghana to show grateful them be to Baba God.

Good one Jare!


This Our Naija Comedian,Julius Agwu Host The Former Governor Of Rivers State And Their Well Wishers For Him Thanksgiving Party

Julius Agwu host many important and popular people for him thankgiving party wey him hold for him house after the surgery wey him do for him brain.

Thank God you don well again,no sick again ooo! lolz

See Pictures Of Yvonne Jegede And Femi Jacobs Wedding For One Film Wey Dem Act

This Naija Nollywood celebrities dey currently dey act film.

Naija Army Don Allow 5,000 Soldiers To Go Fight Boko Haram

Naija Chief of Army Staff  Lt-General Tukur Buratai,don announce am for Abuja yesterday during the opening of the 2015 Chief of Army Staff Third Quarters Conference for Army Headquarter say them go release 5,000 soldiers to go fight boko haram.

Him say this thing wey him want do so na to boot the morale and reposition the Army.

Ok o! make una fight them well and bring back our chibok girls.

20 Naija People Don Die For Macca

The National Haji Commission of Nigeria (NHCN),don confirm yesterday say 20 Naija Pilgrim die for Saudi Arabia during this year's Haji.

The Chairman of the Commission,Abdullahi Mukhtar talk this one for pre Arafat meeting for Jeddah for Saudi Arabia.

Him say 14 people die from heart attack,and others na sickness,while 6 die from the September 11 crane crash plane.

Make their soul rest in peace.

See How Afrocandy Dey Show Case Her Public Hair For Social Media

All over the entertainment world people know this Naija US base singer and actress,Judith Mazagwu as one hot babe any time any day.

This celebrity currentlty post picture of herself for whatsapp where she dey showcase her mother nature gift especially where she dey wear only g-string and bra dey expose her body.

Ewww!

Netherland Don Join Body With FG To Develop Niger Delta

Netherland don show interest to follow federal government join body make them develop Niger Delta.

The Netherland Ambassador to Naija,mr John Groffen don talk today wey be Monday when him visit the office of the Social Adviser to the President of Niger Delta and Coordinator of the Amnesty Programme,Gen Paul Boroh (Rtd) for Abuja.



See Romantic Pictures Of Yvnone Jegede And Bolanle Ninalowo After When Tem Don Deny Say Them No Dey Date

People dey talk say this two Naija celebrities dey date but them say them no dey date .

But people see them together for the premier of Falling over the weekend.

Base on this picture wey I dey see so,plenty things dey wey them dey hide,because actions dey talk pass voice.

Our Miss Kedeke Singer,Chidimma Don Talk Why She No Like Celebrity Relationship

During one interview with Pulse TV,Chidimma talk say she no like celebrity relationship because of the too much wahala wey dey am,she say them go they claim who is who.

Later she come give reason why she go consider to date a musician,she say e fit be anything but no be music but if Baba God talk say na wetin e go be who be she wey go argue but for her as a human being she no like am.

Better Pikin! I hopeb say na your mind you dey talk o! na question I ask o!

Federal High Court Don Fix 30th September To Hear Saraki Case

Abuja Federal high court don say on the 30th of september them go hear the case of Bukola Saraki case,them come ask the court to stop the Code of Conduct Tribunal.

After when the judge,Justice Ahmed Mohammed don listen to the argument from counsel to the parties in concern.him talk say the time don reach to hear the accused person.

See How This Beautifully Made Actress Julliet Ibrahim Dey Shine For The BM/Pro Cover Girl New Edition

The Banke Mershida beauty brand owner dey target to showcase the top makeup artiste and beauty entrepreneur herself wey tap renowned  faces for "flawless beat"

The latest edition na "Humanitarian Celebrity" the theme dey very colourful and soft.

You too fine Jareeeee! True true you be your mam pikin.

Make Una See Pictures Of Our Naija Actress,Uzo Aduba As She Dey Cry When She Dey Collect Her Second Emmy Award

This 34 year old Naija actress don win her second Emmy Award on sunday night for Emmy award for Los Angeles.

She win the best supporting actress for the role wey she play for one drama series in Orange is the New Black.

She come dey cry tear of joy as she dey thank her family,show cast and crew for the honour.

Ehyaaa! No cry you hear,you deserve am.

This Ghanian Beautiful Actress Talk Say she Prefer To Marry Obodo Oyibo man

This award winning actress talk say she dey struggle with African men because of their mentality.

According to her,she say the mentality dey make them withdraw to date celebrities.