Friday 18 September 2015

This Our Fine Oyibo Singer John Legend,Him Wife Don Open up On Pregnancy Wahala

This oyibo singer wife Model Chrissy Teigen open up on how she and her romantic husband dey struggle to get belle.

This 29year old model dey worry say she never carry belle and the thing dey pain her seriously.She say she marry her R&B husband at the age of 20 and now she don almost reach 30 and her husband also be 36 year old.She dey talk seriously say she want get big family with her husband,

 She even talk say true true she and her husband dey get wahala because dey for don get this pikin since five,six years ago but dem no agree and now wey the two of dem dey busy,dey always dey for road dem they find am hard to born pikin.

Shai! I pity this two celebrity o,e no easy to become celebrity,no worry Baba God go give una plenty children,una hear!

No comments:

Post a Comment