Nawa o!people no go mind their business,wetin concern them if person space her pregnancy or not abi na them go help her cary the belle? My people abi how una take see this mata/
People wey interview Mercy Johnson Okojie recently talk say the mother of two children don get belle again and she say nothing dey wrong wit her if she no space her children.
The actress talk say she get belle and she dey married so she no understand why people go dey ask her dat kind of question,she say she know the rules of spacing children but she be married woman and she be adult,so she fit decide the way she go live her liffe.
the people wey support Mercy be 74.4%,while people wey no support her be 8.5% while people wey no know wetin dem go choose be 17.1%
Abeg aunty mi carry go, no mind wetin dem dey talk,afterall Baba God talk say go into the world and multiply.Abi no be so my people? lolz!
No comments:
Post a Comment