Thursday 17 September 2015

The Ex-Governor of Benue State Suswam,Don Show Him Regret.Him Talk Say Him Dey Ready For EFCC

For the first time,the ex-governor of Benue state Dr Gabriel Suswam don talk truth about the corruption wey dem talk about am.

According to wetin the Nation talk,Suswam talk say him no dey fear Economic and Financial Crime Commission (EFCC).The ex-governor talk say the reason why People Democratic Party fail for the last election na because of say the Party no dey serious.Suswam talk say since him no ask or find out things about him predecessor,him too no expect say him successor to ask or findout anything about him administration.see wetin him talk,

 "For the touch light wey dey happen for Benue state.no be say anybody dey fear but once any past event set,na double edge sword,you no know who be him turn tommorrow,you no know tommorrow"

 "Him say when him become governor of Benue state,him meet some wahala for ground and him solve peacefully.When wahala dey make we solve am peacefully.Him say na him own way of life be that,him dey encourage Benue people make dem stay peaceful"

  Him come finally talk say "PDP still dey strong for Benue state,the Ogas dey and that is why dem come meet am,the opposition party and e come with plenty pains"
 
 Shai! no cry you hear,even the bible talk say na wetin u sow na the same thing you go reap.Abeg no be me talk am o,na wetin bible talk.

No comments:

Post a Comment