This Senate president dey worry so him come go beg the islamic leaders wey dey for Kwara state make them pray on his behalf.
So the head of Maja Forum,the coverner of the prayer talk say them wey dey Kwara no get power,him say the only thing wey them fit do na to support am with prayers.Them no get money,soldiers,money or any other security agencies,them just be ordinary citizens for Kwara And Naija but them for Kwara especially Ilorin belive in the prayers.
Them talk say them don organize 500 Imans and over 1000 dey pray for Saraki in different areas.Them don dey pray and fast,even the women dey pray for am because Saraki they help them well well,even the ones wey no go school no want make anything happen to Bukola Saraki.Them say them no dey sleep,them dey pray untill Saraki trials go end.
Ehyaaa! Shai! No small prayers be this ooo! Na when things happen like dis na em people go dey remember say there is God,i no call anybody name o!!!
No comments:
Post a Comment