Sunday 20 September 2015

See Serious Accident Wey Kill 9 People For Calabar Odukpani-Ikom Federal High Road For Inside Cross-River State

Serious accident happen on Friday by 10pm wey kill 9 people involving one trailer and two buses.

E never reach one month wey 6 people die for accident for the same place.Dem say na one trailer driver wey no want to follow triffic rules go cause this accident,th trailer go jam two buses wey dey come form the opposite side of odukpani road.

One eye witness talk say the trailer dey come from Ogoja to UNICEM plant for Mfamosin to collect cement na him the trailer wan over take the traffic not knowing say many cars park for front,so the trailer lost control come hit three buses wey kill the whole passengers for two commercial buses before him come hit another truck wey dey come from the opposite.

But the Fedral Road Safety confirm say na 9 people die for the accident,while eye witness talk say maybe na 20 passengers die because each of the buses dey carry 10 passengers.

Nawa o! This kind thing dey painful well well,i no know why people no dey like follow traffic rules,them like to dey do as if them know everything now see wetin impatience don cause na.Truck drivers abeg make una dey follow traffic rules and also commercial buses and private cars because this life no get duplicate o! For those people wey die may their soul rest in peace and make Baba God console the family of those people wey die,Amen.

No comments:

Post a Comment