This handsome actor talk say him wife don sabi speak igbo sharp sharp,him also talk say him wife dey speak eighteen languages.
For one interview with New Telegraph Ogbonna describe him wife as
"My woman na God-fearing woman,she dey intelligent,she dey speak 18 languages,she dey learn fast,she dey even speak Igbo sef. She be person wey dey believe in positive things,she no dey allow negative things for our relationship.We no dey fight,we be like best friends.Sometimes sef we no dey think say we dey for relationship,we be very good friends and we dey go out together,we dey also do things wey i fit do wit my house boy" Na so him talk about him wife.
Even the actor talk wetin him wife dey do too
"She dey do her masters,she dey interpret, she dey work with government people,she be life teacher,she dey teach me things about life and I dey always listen to her very well" Him also talk say very soon the wife go enter Naija.
This kind of love wey make this fine oyibo dey speak Igbo e strong o!
No comments:
Post a Comment