Wednesday 16 September 2015

Nawa o! This kind thing still dey happen for this Africa?....... See how Camroonian Mothers and Girls wey dem iron their Breast with hard and heated objects by their Mama all because of tradition come dey tell their sad story.

This kind thing dey suprise me o! Abi my people how una take see this kind breast ironing? Just because of say dem no want make the breast attract men and boys.According to dem,dem talk say breast ironing na when dey pound and massage small girl breast with hot object so that the breast go stop to dey grow.The reason why dem dey do this kind thing na to try protect the girl from men wey one sleep with dem or rape them.And another reason na to make sure say d girl no carry belle early and spoil the family name so that the girl go fit face her education.
    I dey wonder for this kind thing because some people dey find how their breast go take stand while some people dey flatten the thing....shhhhh! No be me talk o!Na wetin I hear o!....Na my work i dey do,lolz!

No comments:

Post a Comment