Wednesday 16 September 2015

Dija Still Dey with Us---- Na wetin MAVINS RECRDS Talk

My country people Una know say na only me be the Original Amebo Queen wey una get wey fit give una origanal amebo,the reason why i dey talk like this na because of say some people don dey carry fake story dey talk say dis our charming artiste don leave Mavins Records wey come make dem vex, dey come dey warn those fake amebo make dem take their time.Mavins Record say the Babe just go Kaduna, her Mother home town for charity purpose,dem say she never leave singing o!To confirm wetin Mavins Record talk,,
      "No she has not abandoned singing,she only took to teaching for charity,Dija taugh a class of 55 students when she visited Kaduna,her mom's hometown"

Fake Amebos una don hear am,abeg make una leave me make i do my correct work o! Lolz!

No comments:

Post a Comment