This our two Naija celebrity marry in 2013 after when them don date for several years and since then their love dey grow sweet and sweet every day.
As 2 Baba clock 40years today na him beautiful wife nak am one sweet message for instagram dis early morning,see the sweet message wey she write
"Happy Birthday to the Best Man I know...........I love you today and always......@2faceidibia1 God bless you my darling.....Eternally Yours"
Annie and 2 Baba been dey recently for HELLO MAGAZINE where 2Baba confess say him for regret am assumin him let Annie go.
Hmmmm! dis love dey shark the guy o! No be small love be this one o!
Happy Byday to you 2 Baba,we dey wish u long life,prosperity and good health,enjoy your day but no over enjoy o! so that............. i no talk anytin o! lolz
No comments:
Post a Comment