Friday 2 October 2015

See Naija Woman Wey No Get Vaginal Opening Don Born Baby Girl For lagos


Sister Destiny Chimezie na from Isiala Ngwa local government area of Abia state but she dey live for Lagos.People dey always call her boy but her people dey call her Chimezie meaning "make God correct" and na the name na boy name.




Her Family members don do everything to change the situation of the woman but no result,them go different hospitals and maternity homes but no result.During this period her mother come leave her father because of the shame Destiny bring to their family.

Neighbors dey mock her family so the mother no fit stand the shame,so she leave the father.But her continue to find solution to Destiny problem to the extent wey be say the wahala come dey too much and him come die for accident.

For Lagos University Teaching Hospital(LUTH)the consultant wey examine her come findout say her viginal no form well.So na during this period Destiny meet one chosen brother wey marry her and him talk say him believe say nothing dey impossible with God and God come visit her during The lord"s Chosen programme tittle"ONLY GOD CAN DO THIS" last year and God miraculously open her viginal.

So she come get belle born bouncing baby girl,she dey among the people wey dedicate her baby on sunday for the Lord's Chosen Charismatic revival Ministries Headquaters Ijesha .

This one no be small miracle oo!

No comments:

Post a Comment