Monday 19 October 2015

Nollywood Veteran Actor,Zack Orji Don Talk Say Him Be Pastor Since 3 Years


This our Naija actor,Zack Orji wey don act over hundreds of movie talk for one interview with City People say him don become reverend since 2013.

Him talk say him be ordained reverend and pastor so him dey get invitation to minister for different churches both within and outside naija,him say even him currently get angagement for South Africa this October.

As him dey talk why him decide to be a pastor,him talk say him no ready to become reverend,na him Bishop wey God probably inspire am to ordain am.

Him Say him dey worship with Power Line Bible Church wey dey under Bishop Lawrence Osagie,and him ordain am in 2012.Him talk say even before them ordain am him bin dey receive invitations from different places to come minister,so when the offer come from him bishop to ordain am him no reject the offer.Him take the offer with him whole heart and him come dey happy as him come get opportunity to talk with people,inspire them and draw them closer to God.

This one na better thing bross! God go strengthen u in ur ministry!!!

No comments:

Post a Comment