Thursday 17 September 2015

Una Don Hear! Our Oga Presido Buhari Wan Give Boko Haram Freedom And Him wan give Condition

Hmmmm! Baba God abeg na your Leg I dey o because people wey dey Your hand don over plenty even dey fall sef,atleast before U go raise Your leg You go see me,because me no understand why dis boko haram people no wan bring back our girls and leave our peaceful Naija alone.
 Oga Presido Buhari talk say if boko haram bring back our girls him go release boko haram prisioners wey dem catch.According to wetin Punch Newspaper talk for one interview wey Oga Buhari attend with Agency France Press dem talk say,dem wan try see weda dem fit negotiate with boko haram prisioners wey dem catch so that dem go free our Chibok Girls and if dem free our girl complete,Oga Presido fit give dem freedom.
 Dem also talk say dem wan see weda dis boko haram dey qualified,how useful dem fit be,weda dem don reach the position of leadership where their absent dey important to the operation of boko haram.
  But wait o! why Oga Presido go dey negotiate wit dem sef? abi no be our Law talk say no one dey above the Law? Thats why I say na God Leg I dey o! i no talk anything o! abi una hear anything? lolz!

No comments:

Post a Comment