Friday, 2 October 2015

Lagos State Government Don Close Chinese Company Because Of Workers Death


Lagos state government don shut down Hongxing Steel Company Limited wey base for Amuwo odofin local government area over violation of safety.

The state government give out stop work order because of the death of one of their casual worker,Mr Emeka Umoh wey get serious burns  after wey them pour liquefied iron for him body on September 23 2015.

Them find out say the man die for Lagos University Teaching Hospital where the management rush am for treatment.

Director General of the Lagos state Safety Commission LSSC,Mr Fouad Oki talk say when him visit the company the saftet conditions of the workers dey very very bad and after the visit the company refuse to agree to the state safety standards.

Na God go help us for this our Naija,because wetin this them oyibo company dey do we naija people dey terrible!

No comments:

Post a Comment