Monday, 21 September 2015

E Be Like Say Governor Ambode Go tell Us The Members Of His Cabinet This Week

According to reporters them talk say Ambode fit reveal the members of him Cabinet tomorrow wey be tuesday.

Ok o! We dey wait.....

Police men Don Save One Business Man Akeem Amoo Wey them Kidnap for Ouyole Ibadan And They Beat the Man Until Wey He Almost Die

Kidnappers kidnap this Lagos base 54 year old  business man on sunday for Ese Apata Abanla village Ibadan for him mining and quarry organization when him go pay him workers and contractors wey dey supply am diesel.

The kidnappers beat the man to the extent wey be say the man nearly die and them come put am for one Toyota Hilux van with one of him workers.Them come carry the two of them for one Idi Ayunre in Oluyole LGa of Ibadan na for there police people come save them on sunday afternoon.

Police people talk the man carry 2million for the boot of the Honda Accord wey him carry come meet him workers wey him wan pay them.

Abeg if any body know the man make him or her meet police for oluyole because the man dey collect treatment for hospital.

Them Don Kidnap The Ex-SGF,Olu Falae

Reports don talk say them don kidnap the Ex-Secretary to the Government of the Federation for him house wey dey for Oba-Ile road for Akure in Ondo State.

This 77year old politician be the former secretary to the military government of Ibrahim Babagida from January 1986 to December 1990 and alsoshortly the Finance minister in 1990.

Him be contest for Naija presidential election in 1999 against olusegun Obasanjo.

Kidnapping don too much for this we country o!

Today Na Mike Ezuruonye Birthday

Happy birthday to our Nai

This Naija Handsome Actor,Chidi Mokeme Don Put Picture Of Him And Him Cute Baby Boy

This one na Lovely Picture....

Make Una Check Out The Beautiful And Sweet Pictures Of Our Nollywood Actress Chacha Ekeh Faani's Daughter As She Celebrate Her Birthday

Dis baby girl too fine ooo!

NEMA Talk Say Three Bomb Don Blow For Maiduguri

According to one spokesman for National Emergency Management Agency (NEMA),Ibrahim Abdulkadir,he talk say the bomb blast happen for Gomari and Ajilari areas for Maiduguri by 7:20pm yesterday.

One of the soldiers talk say maybe this bomb blast dey connected to boko haram.